True
2342;
Score | 149
Quietly Loud Creative Writer | History Student | Learning People and Processes @ Lagos State University
In People and Society 3 min read
"Not Just Weight, The Silent Wounds Of Body Shaming"

For Mama Precious compound, children dey play,

but na the wahala wey dey fly for their mouth dey loud pass their laughter.

“See her yam leg!” one pikin shout.

Another one laugh, “Him nose bend like spoon.”

Dem dey laugh no be because e funny,

but because nobody don tell dem say words fit wound pass slap.

Tife waka pass the mango tree, her scarf tie tight wella

no be because of sun,

but make her ear no show.

Aunty don tell her before say, “You sure say na ear be this or satellite?”

Chinedu just dey keep quiet for class roll call,

him dey pray make teacher jump him name.

Why? Dem dey always talk say him voice “be like woman own.”

Inside many African houses,

we sabi how to chop better food,

but we no sabi mind our mouth.

“You too black.”

“Your eye dey sleep?”

“See your hand don shrink finish.”

We dey drop all these insults like groundnut for veranda

so easy,

so casual,

but e dey cut deep.

Dem go talk, “Na joke I dey joke, no vex.”

But when joke don turn wound, who go treat am?

We dey praise strong mind,

but we dey forget say even strong tree fit bend when wind blow too much.

So I dey ask,

Na so we go dey live?

We go continue dey use joke kill person self-esteem?

Dem teach us say make we endure,

As African person we be,

we no suppose cry.

But even lion dey feel pain.

We no go begin tell ourselves truth?

Say body shaming no be culture na cruelty dressed like tradition.

This story na for Tife,

na for Chinedu,

na for the girl wey her lips “too big,”

and for the boy wey dem dey yab say him leg bend.

Na for all the people wey dem don tell say dem body no good enough.

So today, I shout am loud

"BODY NA BODY."

"FACE NA FACE."

Beauty no get one shape or one colour.

Na many ways e dey shine.

Make we stop to laugh when we suppose listen.

Make we stop to wound when we suppose hug.

Say no to body shaming.

Say yes to love wey loud and clear.

See people well. Hear dem well. Feel dem well.

"Let this be more than story, let it be a mirror. So when next you wan talk, look am well. Because word no be stone, but e fit break heart."

insight image
"Not Just Weight, The Silent Wounds Of Body Sha...
By Quietly Loud 10 plays
0:00 / 0:00

Enjoyed this piece? A little tip goes a long way.

Other insights from Quietly Loud

Referral Earning

Points-to-Coupons

Insights for you.
What is TwoCents? ×