" Five years of toil....
" I spent five years in Uni Abuja .... dawn I stand to move my nights were sleepless
"Studying crops and environmental protection in the field of agriculture a course that made me helpless
"From 8am to 5pm Monday to Saturday I Dey try grind
"Lectures back to back untop pest management my brain just Dey unwind
"Uni Abuja sun hot like say them open hell fire
"Dust, rain , cold , heat I just wan graduate I don tire
"My struggles be like say I carry heavy weight for back
"Heavy and hard so real like a farmer with a never ending task
"100 level days ... be like say dem Dey pane beat me everyday
" running from one venue to another because lecture hall no Dey
"Up and down with assignments, with a stressed out hand
" Course rep Dey like gold
" dem Dey behave like say God no create them from clay mold
"I struggled to cope with the academic pace
" Exams came I reason say no be like WAEC
"e be like slap for face
" But Omo if agric call I no fee loose the race
"200 level came with three carry overs
"I cry like say I be pikin, thought I couldn't sustain
"But I still stood strong i gallant and I faced the academic chant
"More stress , pressure Dey but I Dey hold on tight
"Because agric Dey call I say I wan make am right
"300 level come....it became tough
"E be like weed wey Dey make farmer land rough
" More courses , assignments boku, I Dey work like crazy
"But I scaled through.. with focus and might
"400 level hit me hard with a twist of pain
"I carry wound for leg because of IT strain
"Agric no easy ... I felt like fighting up
"But remembering how far I've come made me stand I no stop
"500 level come
"I think say I go rest
"But na war I enter project wahala and stress
"Three species of garden egg under rain and hot sun's mess
"I planted, monitored with castor oil's might
"I no care say danger Dey I just wan make e grow bright
"Morning till 7pm I Dey farm under sun under cold
"Money just Dey plenty Dey go but my spirit no wan retreat
"My supervisor Dey like olopa do this do that
" instructions wan kill me e no gree me rest
"Insect Dey bite me for inside bush wey I Dey
" but I tell myself not to worry because i know the pain will fade away
"I thank God for my parents their support Dey like constant fight
"I kept on going with a frown on my face tears and sweat but I still worked through the pain
"Defense day carry em own come
" my heart Dey beat like drum
"Question upon question I Dey answer them one by one
"But I survived strong and gallant ... I won
"The cost was high the journey was hard
"Memories of struggle still dey linger for my yard
"My struggles, my sweat , my tears don finally pay off
"I can finally rest my brain like light wey dem switch off
"Because I don collect degree na my pride and joy for life
" But in my next life if I hear agric I go run like say dem chase me with knife !
356





