Garri, garri, garri, rice, rice, fuel — 1,300 per litre.

I thought we eat food, but I digest sapa.

Omo, how I wan take japa?

I remember that time I dey sing for my mama,

I go dey disturb my papa,

“Say we are the leaders of tomorrow, pay our school fees, give us the best education.”

Yet even the almajiri wey dey beg for road dey earn daily pass me wey get BSc.

Leaders of tomorrow, but since independence,

All our presidos dem born dem before independence.

Leaders of tomorrow don become ashes of today.

Are we independent or living in dependence?

Claiming Gen Z, but we're like the stone age with phone.

Gas — 2k. Everybody manage firewood.

We stand behind political parties, flags and symbols,

Because Iro and buba, the Igbo chieftaincy cap, the Hausa attire and other tribal outfits cannot be raised as flags.

So we cover tribalism under the name political parties.

Go to school, leaders of tomorrow, parents pay the fees.

Payment of fees, school on strike.

Payment of fees sits on blocks.

Payment of fees, code on paper.

Payment of fees, foamless beds.

Payment of fees, hunger strike.

First class graduate, second class upper in food and dietetics; now, pap seller.

Go to school, go to school, now it's learn a skill.

EFCC gallant where yahoo boys dey,

But where politicians dey embezzle money, dem dey like blind men.

Omo, BSc holder don drop certificate, dey hold POS.

Anything to hold body and soul together.

May my mates no tag me almajiri.

Mr. Urgent 2k.

Uniforms and punishment for lateness,

Ties that came in different colours, yet signified d same thing.

Slavery in your own land.

Voters card ready, ballot boxes snatched, votes rigged.

Suddenly, it's no longer democracy but turn by turn, e mi lokan.

And this democracy is now Dem go crazy.

Finally, go to school advice heeded.

10 yrs for the 6-7 yr medicine course.

Hospital strike, doctors no pay, bank accounts negative, still paying student loan.

Doctor leaves, patients die, people say doctors are not patriots.

So tell me, what is patriotism?

To stay and die trying,

Or leave and still survive?

Even marriage no be do or die affair.

Divorce dey, temporary separation dey.

Buh if I leave, I don become bad citizen, my love don die.

I love my country, I no go lie.

Na inside am I go live and die.

If e twist me, so I twist am so.

E push me, I push am, I no go go.

But this love wan kill me before I even begin live.

As I take love you, I'm sorry I can't stay.

Absence makes the heart grow fonder, so allow me to love you from a distance.

Because this sapa

Is reducing my only clothes to wrapper.

Yes, wrappers, because my trousers no longer sit on my waist.

The properties to my name I'll sell off.

Sit in economy class and japa.

When I come back home, I'll be a big man.

Or I'll cross the Mediterranean Sea, hoping it parts for me like the Red Sea parted for the Israelites, or swallows me like the Egyptians.

Because either way, this daughter of the soil,

Living on this soil might still be killed.

But if I make am,

I no forget you.

Because, oh my home, when shall I see my home? When shall I see my native land? I will never forget my home.

Ogbono no go dey where white man dey.

I no go really enjoy the weather that one dey.

But I no go dey fear bandits.

Bad as e bad, I be student there, I go dey earn small small.

Bad as e bad, I go graduate well.

Bad as e bad, I go get good job.

I love you, Nigeria.

Only me no fit change you.

Only me no fit give wetin you deserve because you self no do me well.

So if I go, I go start dey help my maale and papi.

May dem self help community.

But me alone no fit drop fuel price.

Me alone no fit give the masses wetin dey deserve.

This love wey I love you requires me leaving so I can be among the living.