False
Score | 154
Abisolina Student @ Adekunle Ajasin University,Akungba Akoko Ondo State.Nigeria.
In Relationships • 1 min read •
My Val gift.


My Valentine gift no be chocolate and teddy bear,

no be money or flower bouquet.

no be cards and food tray.

no be red gown and fine dinner.

Na small nylon wey I carry go junction.

I buy garrium.😎

I buy sweetner.

I buy floating berries.🥜

I buy pure water.

I add London roasted plantain and corn join.

No fancy package,

no long love message,

but my heart still dey smile small.

I reach house,

pour garrium for bowl,

add sweetner like say life still sweet somehow,

pour pure water steady steady,

shake am well.

I siddon for corner,

mix am with floating berries,

I dey enjoy the life of my head with roasted corn and plantain.

dey chop am like Queen wey no send anybody.

Because sometimes,

self-love no be big big things.

Na garrium wey you buy for yourself

when nobody remember you.

This Valentine,

my gift to myself

na survival.

Na strength.

Na me choosing me —

even if na with garrium and floating berries. 💛


NOTE:If I no love myself abeg who go con love me?😎


|
This year valentine is soooo bam.
5
views 264
comments icon on TwoCents 6 share

Abisola has 5 badges
badge
badge
badge
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from Abisolina

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning


Insights for you.
What is TwoCents? ×