True
7337;
Score | 95
Empress Suzzie Nigeria
Student @ Federal University Oye-Ekiti
Ado-Ekiti, Nigeria
568
230
37
23
In Nigeria 1 min read
Naija, We Still Dey Hope

Naija,

you be laughter wey hide tears,

you be hope wey survive fears,

you be mama wey no get much,

but still go share the little wey she touch.

For your streets,

dreams dey walk with bare feet,

students dey chase tomorrow

with empty pockets and heavy thoughts.

We dey read under candlelight,

pray say our story no go end for darkness.

Your children dey travel far,

not because dem hate home,

but because home don make survival

look like a competition.

Still,

see us.

We dey dance when the rain fall,

sing when the power return,

laugh inside danfo,

turn suffering to content,

and turn “God abeg” to everyday language.

Naija,

you wound us,

but you still dey our heart.

We complain about you,

yet defend you anywhere.

We curse your problems,

yet dream of fixing them.

We leave your shores,

but carry your name inside our tongues.

Maybe one day,

the child wey dey ask,

“Why Nigeria dey like this?”

go grow to become the person

wey go change the answer.

Until then,

we go keep hoping,

keep praying,

keep pushing.

Because beneath the hardship,

beneath the noise,

beneath the broken promises—

Naija still dey breathe.

And as long as she breathes,

we still get hope. 🇳🇬

Other insights from Empress Suzzie

Referral Earning

Points-to-Coupons

Insights for you.
What is TwoCents? ×