True
Score | 344
#Lightwords✨ Nigeria I'm a fashion designer and a student @ FUOYE
In Literature, Writing and Blogging • 1 min read •
Get up,make we try again

GET UP, MAKE WE TRY AGAIN.

Omo, life fit humble person sha.

You fit try your best, do everything wey you know how to do, and still end up on the floor wondering wetin you do wrong.

And e dey pain pass when everybody around you seems to dey move forward while you feel like say you never even start.

But see this picture.

One small boy fall, and instead of laughing at am, another boy stretch him hand and tell am, “Get up, make we try again.”

Simple, abi?

But imagine how many people for this world just need that kind encouragement. No judgement, no unnecessary advice, just somebody wey go remind them say one failure no be the end.

And sometimes, that person wey needs the encouragement na you.

So abeg, if things never work out for you, no use am judge your whole life. You fit rest. You fit cry. You fit take your time.

But no conclude say your story don finish because one chapter hard.

Omo, get up. Make we try again.

Maybe this time, things go make sense.

12
views 18
comments icon on TwoCents 11 share

Faith has 4 badges
badge
badge
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from #Lightwords✨

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning

Insights for you.
What is TwoCents? ×