HOSTEL PALAVA
This hostel palava.
One very funny shitty stuff.
Nobody dey close to portal before,
but now everybody don become the portal
where one put their portal.
I no really understand wetin that one mean,
but na so e be.
For close to three months now,
everybody don dey away from their portal.
But as the year enter October,
everybody activates.
Nobody wan lose guard.
Everybody wan dey alright,
wan balance,
and wan get space to stay
because dem no even get bridge for Ayingba.
This is my hostel palava.
Who wants space?
Who gets space?
Who wants to buy space?
I get to resale 70K.
I no sell pass that one.
Who wan swap?
Who wants to go upstairs
make I come downstairs?
Who wants to buy space?
This is my hostel palava.
Because tell me why
I dey on my portal since morning?
I pay portal fee of 5K.
The portal dey stress my life
like say that 5K wey I pay,
I no fit use am buy shawarma,
chop,
cross legs,
dey chillax.
But na because say I no get lodge.
This is my hostel palava.
As I no get lodge
and I no get 580K
to give those Ayingba agents,
wey no dey even think say na students we be
and we gats hustle and chop.
I go use the one wey na 40K and 30K
dem dey show me.
I see better hostel of 30K,
but dem dey show me make I pay 20K.
How now?
Portal fee of 5K.
Wey I pay unko
Portal wey dem don dey work on
for the past three months,
e still dey show craze.
I craze pass am,
but na just because
I no be computer
where I go show am
Say I understand the machine language.
This is my palava
I buy third Inkipi
wey na 40K.
Dem carry me go main Inkipi
wey na 20K.
I pay,
thinking say na their portal get issue.
Na glitch dem call am.
Dem, say dem go rectify am.
E glitch o.
E no glitch o.
Make dem rectify am.
Make people get where to run,
put their head inside.
Now everybody don gather
come hostel group.
Everybody don gather come my DM.
Who wants to buy space?
Who wants to sell space?
Who gets space to sell?
I dey upstairs,
who wants to come downstairs?
Who wan swap?
You get 4th Inkipi for sale?
You get third Inkipi for sale?
You get second and main Inkipi for sale?
I wan commot from MH oo
Who want MH?
Who want FH?
This is my hostel palava.
The SUG just dey there,
dey chew gum,
ride bike abi na TVS,
dey move ,e no corcern am
"This is a portal glitch,"
na him dem always talk.
My 5K wey I pay,
wetin lna use am do?
Dem no gree talk.
As I know, say Ayingba no get bridge,
before I go talk say
I go sleep under the bridge.
Glitch o.
No glitch o.
Make dem find space for me.
make I wrap myself
put inside,
even if na for the meantime.
DIS NA MY HOSTEL PALAVA
91





