My name na Nkiru.

If u dey read this thing naw, e mean say u don find my letter.

Welcome to my thoughts. Walk with me, leg no go pain u.

Abeg carry small chair with you cos you cannot turn back o. 🔪🪓💣

I dey for my village jeje.

E get this satellite Wey my neighbour buy. E be like say the name na Gotv.

Dat thing sweet me for belle anytime I dey watch am.

I even pack go my neighbour house because e get two channel Wey I dey always like well well.

Zee World and Rok TV.

Zee World love dey sweet me for belle. I like Twist of Fate well well. Na every night dem dey show dat one.

Na e I ask myself, na so love sweet and easy?

Poor girl go just dey marry rich man anyhow.

Twist of Fate na my own story o.

Cos dat girl na from the village and the man Wey be her lover na one rich man from the city. Deir love sweet.

Eiiii.

See mansion for inside film.

Na God go punish Emeka oo.

Dat boy na very useless boyfriend.

Na me go dey give am money to barb hair, na me go still give am pocket money. Na me e go con dey dump all e frustlations on.

For our relationship, na me be pepper, na me be salt, na me be dust bin. Everything na me.

Make e con learn from Abi. See as e dey pamper Pragya.

I don break up with am sa.

I need find dis kind love o.

My friend Ngozi don commot from village. She talk say her dream na to be a doctor.

Me, my own dream na to fall in love with a good man Wey get money.

I wan commot this village too.

I for go India because their love sweet, but I no get money for aeroplane.

So, I go go Lagos.

Na Lagos Nollywood love dey happen wella.

Ahhh.

E get one film Wey I watch for Rok TV Wey sweet me well well.

I don forget the name.

But the girl na poor girl. Very poor.

She con dey do Sakara for rich man.

She even slap am when e come her house.

She talk say he be play boy.

The man no even touch am.

E talk say he like say she be expensive babe.

Haaa.

Last last dem marry.

You too dey see am abi?

Go wear glasses if you no see am o.

Me I dey commot this village by next month o.

I don call my aunty Wey dey Lagos. She don agree say make I come.

I don dey cook food for people and collect money so I go use am buy fine clothes for Lagos.

No worry.

I don practice Nollywood wella.

Sebi na to slap rich man and pour water for their body…I go do am.

If love no find me, I go find love myself.

Lagos, wait for me.

Nkiru is coming.

✍️Gift Olabode

If you wan see wetin go happen to Nkiru for Lagos, follow me for part two.🙂↔️
At the end of the month, we give out prizes in 3 categories: Best Content, Top Engagers and
Most Engaged Content.
Best Content
Top Engagers
Most Engaged Content
Best Content
We give out cash prizes to between 7 and 20 community members with the best insights in the past month.
The winners are picked by an in-house selection process.
The winners are NOT picked from the leaderboards/rankings, we choose winners based on the quality, originality
and insightfulness of their content.
Here are a few other things to know for the Best Content track
1
Quality over Quantity — You stand a higher chance of winning by publishing a few really good insights across the entire month,
rather than a lot of low-quality, spammy posts.
2
Share original, authentic, and engaging content that clearly reflects your voice, thoughts, and opinions.
3
Avoid using AI to generate content—use it instead to correct grammar, improve flow, enhance structure, and boost clarity.
4
Explore audio content—high-quality audio insights can significantly boost your chances of standing out.
5
Use eye-catching cover images—if your content doesn't attract attention, it's less likely to be read or engaged with.
6
Share your content in your social circles to build engagement around it.
Top Engagers
For the Top Engagers Track, we award the top 3 people who engage the most with other user's content via
comments.
The winners are picked using the "Top Monthly Engagers" tab on the rankings page.
Most Engaged Content
The Most Engaged Content recognizes users whose content received the most engagement during the month.
We pick the top 3.
The winners are picked using the "Top Monthly Contributors" tab on the rankings page.
Contributor Rankings
The Rankings/Leaderboard shows the Top 20 contributors and engagers on TwoCents a monthly and all-time basis
— as well as the most active colleges (users attending/that attended those colleges)
The all-time contributors ranking is based on the Contributor Score, which is a measure of all the engagement and exposure a contributor's content receives.
The monthly contributors ranking tracks performance of a user's insights for the current month. The monthly and all-time scores are calcuated DIFFERENTLY.
This page also shows the top engagers on an all-time & monthly basis.
Below is a list of badges on TwoCents and their designations.