False
4121;
Score | 88
Ameerah Abdulsalam Nigeria
Student @ University of Abuja
Abuja, Nigeria
481
86
14
20
In Career and Jobs 2 min read
Tears on Nigerian street

"For Lagos heart.... where sun dey hot

"Where dem dey sell pesin dreams..

"Expectations dey wey me down like say na heavy load

"Them Dey press me... no care , no love, nothing Dey for streets

"I Dey chase Naira steady hustle game wey no dey end .. for here even two sure odds go pend"

" Trade nights for days

"Still I no fee claim

"The life wey I want .. the life wey I deserve

"Just salary, roof, bed...all na serve , serve , serve

"Disappointment dust just Dey hold me for neck

"Corruption Dey tear us peck for head

"Dreams Dey Waka up and down like my own for city wall

"But I still gallant like morning sun

" my heart heavy, my soul undone, but I go find way talk

"For night silence boku , I pray, I fight

"For peace wey Dey in midst of chaos, I release

"Wound Dey my body but I carry am like armor

"Na survivor I be for Naija rain and storm

"I Dey testify to resilience, strength and shout Wei Dey shout

"I shake like morning dew

"Commot dust from my shoe, start my Waka anew

"I Dey find my voice.... Dey gather my strength... I carry my length

" for quiet.... I Dey house

"Where noise for world don calm down

"My chest heavy die.... I don tire...but I still  gallant

" I go find strength for pain, resilience .... pain no go Dey

" For Naija wey I Dey I go live and my hustle go pay

Other insights from Ameerah Abdulsalam

Referral Earning

Points-to-Coupons

Insights for you.
What is TwoCents? ×