Lamborghini for sale o!Β

My people, una come patronise me π
No worry, e no cost to enter my DM and ask for the price. But abeg, no do fake TF o! π
How una see my Lamborghini?Β
Hope I tried?Β
I never really get the chance to use my pencil set since I bought it because of exam wahala. But yesterday, I finally picked up my pencil set and decided to draw something βοΈΒ Β
And see the result! My own Lamborghini don land π
But make I tell una the story behind this drawing π
Somebody sent me this Lamborghini drawing. The person dey draw too, and sometimes e dey collect my drawings to try them out
So recently, the person sent me this Lamborghini picture, saying e wan try amΒ
I remember telling the person say I go try to draw am too
But instead of waiting for the owner of the drawing to draw am first, I decided to try my own hand first π
Omo! I don carry person assignment do my own assignment
Before una go accuse me of stealing another person work, make I clear my name first
I NO STEAL AM O!Β
The person sent it to me, and we even discussed it. I just decided to try my own version before the person drew hisΒ
Besides, na drawing we dey draw, no be competition π
If you fit draw something wey I draw, draw am. If I fit draw something wey you draw, I go try am too
We go learn from each other, improve together, and still catch cruise along the way
But make I ask una something...Β
If you see this my Lamborghini for road, you go enter am or you go first ask me for receipt? π€£
Abeg, rate my Lambo from 1β10. Make una no use pity mark o!
But pity me small sha πΒ
@DMY Art π¨Β
119





