True
Score | 54
In Literature, Writing and Blogging 1 min read
Omo My Eye Shine

The year was 2010/2011. Me and my Nokia C3-00.

That time, Java phones still dey on point. 100kb games, EDGE browsing wey feel like lightning (omo, things were slow o). Carrying that phone back then was a whole lifestyle.

See me feeling myself na… anyway, that's by the way.

Our story starts the day guy man go buy fuel. I no know why our pockets sabi dey loose that period.

I carry my empty jerrycan enter taxi, sure say my phone dey my pocket.

Na so I drop for Oando along Mothercat, Trans-Amadi. As I dey come down, I check my pocket…

Heartbreak.

Phone don slip out.

Omo, my eye shine. Fever catch me, throat dry once. And the taximan don go far.

I chase that taxi like Temple Run, from Oando straight reach GTBank area, dey pray say somebody go stop am for where taxi no dey stop. When e finally stop, na wrong taxi. I wan mad.

Na so C3-00 and my 100kb games waka go. Chai, heartbreak.

4
views 71
comments icon on TwoCents 1 share

Edward has 3 badges
badge
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from Crucible

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning

Insights for you.
What is TwoCents? ×