True
Score | 178
In Education 2 min read
Stop Looking Down On Art student

For Naija, if you say you be art student, some people go look you like say you no get sense.

I'm speaking from experience

I don hear am tire.

"Why you no do Medicine?"

"Art na for people wey no sabi science."

"Na so so story you go dey read for 4 years?"

I dey 100 level. Art department. And I don see how parents and society dey prejudice against us.

My cousin and my brother's dey science, everybody dey hail them. "Future doctor!" Me wey dey art, dem dey ask "Wetin you go use am do?"

But make we talk true.

Who write the books wey science students dey read? Art student.

Who write the law wey dey govern this country? Art student.

Who dey act film, write song, do news for TV wey una dey watch every night? Art student.

Who go teach your pikin for school? Art student.

Without art, society na empty noise. No story. No culture. No history. No communication. Na just machine.

People think art na easy because e no get chemical formula. But dem no know say to write 3,000 words essay wey go make sense, to stand for class defend your argument, to understand human being and society - na hard work.

Science fit build house. But na art go make the house feel like home.

My papa and mama dey always ask me say "This art so wey u dey wetin u wan use am do but my main purpose and objective nar to show Dem say I dey capable of becoming something with being an ENL student

Art na course. E get value. E get money inside if you sabi am.

So to all parents: Stop telling your pikin say art na useless course .You dey kill im creativity.

And to my fellow art students for 100L or above  like me: No shame for your course. Carry am for head. Because na we be the voice, the story, the culture of this country.

Without art, science na just silent lab.

*My question: You don ever experience this prejudice because you be art student? How you handle am?*

Make we talk for comment 👇

Write about ur say and your opinion about this

5
views 15
comments icon on TwoCents 9 share

Esosa has 3 badges
badge
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from Esosa

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning

Insights for you.
What is TwoCents? ×