False
Score | 437
Muhammad Mercurial Nigeria STRATEGIST OF EXUBERANT INTERNATIONAL WRITERS FOUNDATION. / WRITER AND EDITOR AT IAPWE.
In Arts and Crafts • 2 min read •
WHO AM I ?

Welcome to the Sanga!


Who I be? Na me get my choice. My roots fit explain me, buh na me dey control my voice.


My papa's pain no be my portion. My mama's tears no be my own detention. I respect their experience, but I no dey inherit frustration.


Omo, I no be anybody's trauma. I no be family curse or generational drama. I fit love my people without repeating their wahala.


My papa don see shege. My mama don face her own. But I no go use their scars design my throne.


Friends fit betray me. Mentors fit disappoint me. Lovers fit wound me, but dem no fit define me.


You chop breakfast? Na your experience. You trust person, dem use you do experiment? No turn your heartbreak to my life instruction.


Your ex do you dirty, I no send. Your friends switch up, na your own trend. No come use your bitter past write my end.


I no be victim of your betrayal. Your failed mentorship no be my ally for Sanga. Your relationship trauma no be my manual.


Carry your experience, abeg, shift. No use your brokenness block my gift. Your life blueprint no be my script.


I no dey copy and paste. I no dey let fear set my pace. I get my own race, I get my own space.


If dem fail, I fit succeed.


Wait o! Wetin I talk?


If dem fail, I go succeed!


If dem fear, I go take lead. Their experience na lesson, no be my creed.


I no go pass pain to my pikin. I no go make fear the language dem speak. The cycle go end, even if e end with me.


My heaven baby girl go enjoy, no be endure!


I no come this life to form victim. I no come to beg pain for permission. I come to rewrite the family tradition.


Make dem talk, I no dey shake. Make dem doubt, I go still create. I no need their approval to determine my fate.


Who I be? Na my decision. My future no dey under anybody's supervision. I be the CEO of my own evolution.


I respect the roots wey carry me. But no be every old pattern go marry me. I fit love my origin without letting am bury me.


I be the answer dem pray for. The open door dem dey wait for. The better tomorrow wey pain no fit predict.


Who I be? Na my choice. My roots explain me, but my will defines me. I go forge my own path. If e hard, na me go bear the cost.


SHARP!


|
Step into MD.Mercurial's concept & become "wowed"😮😎🤓

Other insights from Muhammad Mercurial

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning


Insights for you.
What is TwoCents? ×