False
Score | 72
In Literature, Writing and Blogging • 2 min read •
Harvest Never Reach

Harvest Never Reach

‎Written in Nigerian Pidgin English

‎E get days wey I go stand for the back of window..

‎The window wey dey open reach dat small veranda,

‎I go dey watch as the sun dey sink

‎like something wey don tire, but e still wan try dey push.

‎Na der be my altar.

‎I no dey kneel, but I dey pray.

‎I no too shout..

‎But I talk am make God fit hear the load wey I no name.

‎I tell God,

‎"I wan be the one wey go change dis story."

‎Make I grow tall pass where we dey now.

‎Make I build name wey my papa and mama go fit rest inside.

‎Our house no be sorrow house oo,

‎But better and wahala dey live like neighbours.

‎E get days wey rice no go get stew,

‎and days wey the pot go surprise us with many many.

‎We dey laugh. We dey wait. We dey survive.

‎School just be like plastic chair for rainy day;

‎e dey shake like sey e no get strength, and e cold,

‎but e still better to use sidan when every other thing soak and wet,

‎than to stand under rain..

‎And I dey dream.

‎I dey dream say I go carry my people up like yam wey them uproot.

‎I dey dream of more things I go do with my hands,

‎Wey go pass to dey clap for people wey don make am.

‎But dream no dey clear road.

‎Plenty times I try, e no work and I close mouth.

‎I carry plans like harvest wey rot for farm..

‎e sweet for eye, but e no enter plate.

‎Sometimes, for night, I go ask myself,

‎"Dem go live to eat the fruit wey I dey grow?"

‎Still, I dey plant.

‎I dey plant for ground wey don crack,

‎for inside seasons wey no sure say rain go fall,

‎with hands wey no dey wait for 'well done' again.

‎Dem say "river wey forget e source go dry."

‎So I carry my own anywhere I go; my mama sweat and prayer, for my chest,

‎my papa wrinkled hands, for my mind.

‎Na dem dey push me.

‎I no be the harvest.

‎Not yet.

‎But I dey come small small.

‎And I no dey alone,

‎we many wey dey dis same soil,

‎we dey dig with hope, we dey build with bones,

‎we no go die when our dreams never unfold.

‎Na we be the seeds;

‎we no loud, we no dey perfect,

‎but we dey grow. And we dey come.

‎And tomorrow better ready for us.

‎Credit: Ogoke Nzubechukwu Victoria

Tip me nah☺️
4
views 8
comments icon on TwoCents 2 share

Peace has 5 badges
badge
badge
badge
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from 👑Crown D Pen

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning

Insights for you.
What is TwoCents? ×