True
Score | 449
Shuliê - Ink 🖋️ Nigeria Student/ writer / vlogger/ speaker/ Fashion designer/storyteller @ School, Nassarawa state university keffi
In Psychology 2 min read
Life Go Do You Like Dodo Wey Dey Fry Two Times

Life go do you like dodo wey dey fry two times.

‎You go think say you don suffer reach your limit.

‎You don chop breakfast, lunch and dinner of disappointment. You don cry finish. You don tell yourself, “Abeg, make I just rest small.”

‎Na that time life go look you with one corner eye and say:

‎“Rest keh? Turn the other side.”

‎First frying go come when you least expect am.

‎Something you really want no work out.

‎Person wey you trust disappoint you.

‎Money wey you plan for suddenly get another plan.

‎You apply, dem reject you.

‎You try again, another rejection.

‎You go just sit down dey reason your life like:

‎“Abeg, wetin I do this life?”

‎But my brother, my sister, na only first fry be that.

‎Because life no dey always ask permission before giving you another lesson.

‎Sometimes, the second frying comes when you don already think say you are healed.

‎You meet another disappointment.

‎Another delay.

‎Another unexpected problem.

‎And you go shout:

‎“Ah-ah! I thought we had settled this matter!”

‎But see something about dodo...

‎If you fry am once, e fit sweet.

‎But when you fry am again, the colour deepens, the edges crisp, and somehow the flavour becomes different.

‎Maybe life dey do you like dodo because e dey add flavour to your story.

‎The things wey break you today fit become the things wey make you wiser tomorrow.

‎The rejection fit redirect you.

‎The delay fit prepare you.

‎The heartbreak fit teach you.

‎The struggle fit introduce you to a strength you never knew you had.

‎So if life dey fry you again right now, abeg no give up.

‎You no be the first dodo wey life don turn for frying pan.

‎Just remember:

‎You may be getting fried, but you're not finished.

‎One day, you go look back at everything and laugh.

‎You go say,

‎“Omo… so na all these things wan make me become this person?”

‎And you'll realize that life wasn't just trying to burn you.

‎It was seasoning you.

‎So, my dear, if life turns you over for the second time...

‎Hold body.

‎Your story never finish.

‎And who knows?

‎Maybe na the second fry go make everything finally sweet.

I would have written this in English, just decided to give It a different tone.

Hope you still enjoyed it like this ?

Thanks for reading, please engage, upvots, comment and share 🙏.

Please help a writer 🙏 Tips, comment, share, upvots
15
views 26
comments icon on TwoCents 16 share

Shuliê-Spãrklês has 4 badges
badge
badge
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from Shuliê - Ink 🖋️

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning

Insights for you.
Things people have made normal, that isn't normal. (Children)
717 views
106 upvotes
106 comments
What is TwoCents? ×