On my way...
On my way to the land of love
As I dey go, I dey view some beautiful moments
Moments wey I no fit just take my mind off immediately
I kept thinking, "This should just be me." π
Omoh, God when? π’
So I sha continue my journey, still viewing all these beautiful moments
If I no fit make one, at least I go watch other people making theirs
Maybe if I finally get my own, I go don sabi how everything works by then
I no go just dey start from scratch
I go start from the top! π
So I still dey go where I no even know, sha
Just dey follow that road
Before I knew wetin dey sup, the road kon dey turn into a narrow road
Wait o...
Which kind road be this?
When I no dey go heaven?Β
I no even know where I gather that mind from, but I still continued my narrow road
Maybe I fit see my daddy for heaven and ask am to give me the trillions of dollars wey I wan make in the future
Make e just give me the money now
Why wait till future?Β
So I sha continue my journey
At this point, I no dey look any beautiful moments again
My attention don change
I kon focus like person wey thief something and still dey pretend like say nothing happen
I kept my eyes on the road and continued my journey to heaven
Lo and behold...
I saw a light
A very bright light shining from afar
Omoh!
Which kind light be this?
Because this one no fit be ordinary touch light
I moved closer to the light
As I got closer...
Lo and behold!
I saw something I wasn't expecting
An ANGEL! π
Dressed in a WHITE WEDDING GOWN
Yes o!
Na wedding gown this angel wear
I was surprised too π
So na this angel wey dey shine so brightly make me lose focus on every other pleasure and concentrate on her?
Omo, the light was something else!
Although, I must confess, she was worth every bit of my attention
Because this angel had been waiting for me
Waiting for me to arrive
Suddenly...
I looked at myself
Omo!
I don turn another person!
I was now wearing a suit
And not just any ordinary suit o
This suit get level!
Peller self no fit afford to sew am π
I no talk am o πββ‘οΈπββ‘οΈ
Na so I joined my beautiful angel on the stage
I told myself that if I finally got my own, I would start from the top, not from scratch
And guess what?
The wedding started immediately!
I no dey follow una do all those:
"What's your name?"
"Can I know you more?"
"Let's go on a date."
"Let's do introduction."
Me?
I no need all those processes again
Na marriage o!
And I no fear anything
At least, as people always talk, pikin dey bring blessings
So I go born 24 children
That means 24 blessings!
Calculate am yourself π
The wedding was already in progress
We were dancing, having fun and enjoying ourselves
Omoh, the wedding was LIT! π₯
Fast forward to the most important part
The moment everybody had been waiting for
Do you take so-so-so to be your lawfully wedded wife, to love and cherish blah blah blah.....
Before the prophet could even finish his question...
I DON SAY YES!
Omo, I no even allow am complete the sentence
The bride too didn't waste time
She said YES!
At this point, I was already feeling like the happiest man in heaven
Now, we finally got to the interesting part
The prophet looked at us and said:
"YOU MAY NOW KISS YOUR BRIDE!"
OMOOOOOO!Β
JOY FULL MY BODY!
Finally!
After all the journey, the narrow road, the bright light and everything I had passed through...
Na this moment I don reach!
I quickly adjusted my tie
Straightened my suit
Made sure everything was in place
Because I no wan embarrass myself in front of my wedding guests
I had to look handsome for my angel π
I slowly walked towards her
She stood there looking beautiful in her wedding gown
I gently pulled her closer by her waist
She leaned against my chest
We looked into each other's eyes
No talking
Just eye contact
Omo!
You know that kind of moment when everywhere suddenly becomes quiet?
When it feels like everybody has disappeared and na just the two of una remain?
Yes!
Na that kind moment I dey talk about
I no even know how to explain am
If you never experience this kind thing before, abeg go marry too
You are getting old! πββ‘οΈπ
Back to my wedding...
My angel was still looking directly into my eyes
I could feel the tension building
Everybody was watching us
The guests were smiling
Some were already bringing out their phones to capture the moment
Even the prophet was standing there with his mouth slightly open, as if na him wan kiss the bride π
I slowly leaned towards her
She also moved closer
Our faces were getting closer...
Closer...
And closer...
At this point, even me sef, my heart was doing something I couldn't explain
I adjusted my position
She tilted her head slightly
I moved my face towards hers
Our noses were almost touching
The distance between us was disappearing
Omo!
THIS KISS WAS ABOUT TO HAPPEN!
The guests were waiting
The prophet was waiting
My 24 future blessings were waiting! π
I closed my eyes slowly
She closed hers too
I leaned forward a little more...
Just a little more...
Almost there...
AND THEN...
π΅ TIRIRIRIRIRIRIRIRIRI! π΅
WAIT!!!
WETIN BE THAT?!
I opened my eyes
The angel disappeared
The wedding guests disappeared
The prophet disappeared
The beautiful wedding gown disappeared
Even my expensive suit disappeared!
OMOOOOOOOO!Β
NA MY ALARM DEY RING!
Na so this foolish alarm wake me up from my beautiful moment!
I NO LATER KISS MY ANGEL!
ππππππ
F**K!
Who send me to set alarm in the first place?!
Omo, I for don marry by now
I for don become a husband
I for don become a father of 24 children
I for don receive my 24 blessings
But see where I am now
Still lying on my bed!
WITHOUT A WIFE!
WITHOUT CHILDREN!
AND WITHOUT THE KISS! π
I sha decided to draw this my angel
At least, make I have something to remember her by
Na so I picked my pencil and started drawing her
But I used a nose mask to cover her face
Una no go see her beauty o
Because I no trust una!
I no want anybody to see this angel and start looking for her inside their own dreams
Make una no go finish my dream for me before I sleep tonight π
Abeg, if una see this angel for anywhere, no tell her say I don wake up
Make she continue waiting for me
Because tonight...
WE MUST COMPLETE THIS WEDDING! πβ€οΈ
33





