False
Score | 34
Tessy Nigeria Copywriter | poet | creative writer @ Onyibloom kid ventures as a sales representative
In People and Society • 1 min read •
Body shaming

Oke, take this weight gain you too thin abeg

Wear dress wen go cover your neck and leg

Oh nor worry

I don see healthy way to gain weight

E nor go too tey for me to fat just wait

Abeg forget that talk

How you sure say e go work

Jesus!!

Oke, see your chicken leg

You be like bird

If na me be you I for just kill myself

Omo

You flat Sha

I no just dey see the yansh

Na ply board you be?

Even some men sef thick pass this

For front I dey see your curves

But to check your back side

Na full disappointment, which planet you for come ?

Fine girl !!! Come nau

You nor wan answer??

No be say you even fine

Just flat anyhow like poster

Theresa, where you dey tall dey go

Na girl you be. No man go marry you oo

At first all this talk got to me

I even dey consider suicide

I go look my mirror

But I no even dey see my good side

Just flaws upon flaws

Even now as I dey talk the flaw still dey

But who cares

At least my life never end

If I get the body or not

Everybody go still leave this world

I no fit please everybody

No be my own body??

Thank God I didn't take my life

See people wen wan even make me take risk

Obsession to fit in is so real

Don't be a victim to their cruel words

Body shaming is toxic, don't participate in it.
2
views 6
comments icon on TwoCents 1 share

Young has 2 badges
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from Tessy

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning

Insights for you.
What is TwoCents? ×