True
Score | 352
In Arts and Crafts • 5 min read •
MY JOURNEY TO THE LAND OF LOVE ❀️


On my way...


On my way to the land of love


As I dey go, I dey view some beautiful moments


Moments wey I no fit just take my mind off immediately


I kept thinking, "This should just be me." 😭


Omoh, God when? 😒


So I sha continue my journey, still viewing all these beautiful moments


If I no fit make one, at least I go watch other people making theirs


Maybe if I finally get my own, I go don sabi how everything works by then


I no go just dey start from scratch


I go start from the top! πŸ˜‚


So I still dey go where I no even know, sha


Just dey follow that road


Before I knew wetin dey sup, the road kon dey turn into a narrow road


Wait o...


Which kind road be this?


When I no dey go heaven?Β 


I no even know where I gather that mind from, but I still continued my narrow road


Maybe I fit see my daddy for heaven and ask am to give me the trillions of dollars wey I wan make in the future


Make e just give me the money now


Why wait till future?Β 


So I sha continue my journey


At this point, I no dey look any beautiful moments again


My attention don change


I kon focus like person wey thief something and still dey pretend like say nothing happen


I kept my eyes on the road and continued my journey to heaven


Lo and behold...


I saw a light


A very bright light shining from afar


Omoh!


Which kind light be this?


Because this one no fit be ordinary touch light


I moved closer to the light


As I got closer...


Lo and behold!


I saw something I wasn't expecting


An ANGEL! πŸ˜‡


Dressed in a WHITE WEDDING GOWN


Yes o!


Na wedding gown this angel wear


I was surprised too πŸ˜ƒ


So na this angel wey dey shine so brightly make me lose focus on every other pleasure and concentrate on her?


Omo, the light was something else!


Although, I must confess, she was worth every bit of my attention


Because this angel had been waiting for me


Waiting for me to arrive


Suddenly...


I looked at myself


Omo!


I don turn another person!


I was now wearing a suit


And not just any ordinary suit o


This suit get level!


Peller self no fit afford to sew am πŸ˜‚


I no talk am o πŸƒβ€βž‘οΈπŸƒβ€βž‘οΈ


Na so I joined my beautiful angel on the stage


I told myself that if I finally got my own, I would start from the top, not from scratch


And guess what?


The wedding started immediately!


I no dey follow una do all those:


"What's your name?"


"Can I know you more?"


"Let's go on a date."


"Let's do introduction."


Me?


I no need all those processes again


Na marriage o!


And I no fear anything


At least, as people always talk, pikin dey bring blessings


So I go born 24 children


That means 24 blessings!


Calculate am yourself πŸ˜‚


The wedding was already in progress


We were dancing, having fun and enjoying ourselves


Omoh, the wedding was LIT! πŸ”₯


Fast forward to the most important part


The moment everybody had been waiting for


Do you take so-so-so to be your lawfully wedded wife, to love and cherish blah blah blah.....


Before the prophet could even finish his question...


I DON SAY YES!


Omo, I no even allow am complete the sentence


The bride too didn't waste time


She said YES!


At this point, I was already feeling like the happiest man in heaven


Now, we finally got to the interesting part


The prophet looked at us and said:


"YOU MAY NOW KISS YOUR BRIDE!"


OMOOOOOO!Β 


JOY FULL MY BODY!


Finally!


After all the journey, the narrow road, the bright light and everything I had passed through...


Na this moment I don reach!


I quickly adjusted my tie


Straightened my suit


Made sure everything was in place


Because I no wan embarrass myself in front of my wedding guests


I had to look handsome for my angel πŸ˜‚


I slowly walked towards her


She stood there looking beautiful in her wedding gown


I gently pulled her closer by her waist


She leaned against my chest


We looked into each other's eyes


No talking


Just eye contact


Omo!


You know that kind of moment when everywhere suddenly becomes quiet?


When it feels like everybody has disappeared and na just the two of una remain?


Yes!


Na that kind moment I dey talk about


I no even know how to explain am


If you never experience this kind thing before, abeg go marry too


You are getting old! πŸƒβ€βž‘οΈπŸ˜‚


Back to my wedding...


My angel was still looking directly into my eyes


I could feel the tension building


Everybody was watching us


The guests were smiling


Some were already bringing out their phones to capture the moment


Even the prophet was standing there with his mouth slightly open, as if na him wan kiss the bride πŸ˜‚


I slowly leaned towards her


She also moved closer


Our faces were getting closer...


Closer...


And closer...


At this point, even me sef, my heart was doing something I couldn't explain


I adjusted my position


She tilted her head slightly


I moved my face towards hers


Our noses were almost touching


The distance between us was disappearing


Omo!


THIS KISS WAS ABOUT TO HAPPEN!


The guests were waiting


The prophet was waiting


My 24 future blessings were waiting! πŸ˜‚


I closed my eyes slowly


She closed hers too


I leaned forward a little more...


Just a little more...


Almost there...


AND THEN...


🎡 TIRIRIRIRIRIRIRIRIRI! 🎡


WAIT!!!


WETIN BE THAT?!


I opened my eyes


The angel disappeared


The wedding guests disappeared


The prophet disappeared


The beautiful wedding gown disappeared


Even my expensive suit disappeared!


OMOOOOOOOO!Β 


NA MY ALARM DEY RING!


Na so this foolish alarm wake me up from my beautiful moment!


I NO LATER KISS MY ANGEL!


😭😭😭😭😭😭


F**K!


Who send me to set alarm in the first place?!


Omo, I for don marry by now


I for don become a husband


I for don become a father of 24 children


I for don receive my 24 blessings


But see where I am now


Still lying on my bed!


WITHOUT A WIFE!


WITHOUT CHILDREN!


AND WITHOUT THE KISS! 😭


I sha decided to draw this my angel


At least, make I have something to remember her by


Na so I picked my pencil and started drawing her


But I used a nose mask to cover her face


Una no go see her beauty o


Because I no trust una!


I no want anybody to see this angel and start looking for her inside their own dreams


Make una no go finish my dream for me before I sleep tonight πŸ˜‚


Abeg, if una see this angel for anywhere, no tell her say I don wake up


Make she continue waiting for me


Because tonight...


WE MUST COMPLETE THIS WEDDING! πŸ˜‚β€οΈ


|
I wan check if this thing still dey work tip me first make i confirm something 😜
10
views 32
comments icon on TwoCents 12 share

Precious has 5 badges
badge
badge
badge
badge
badge
Learn more about badges

Other insights from Dmy Art πŸŽ¨πŸ–ŒοΈ

Contributor Points

Points-to-Coupons

Referral Earning


Insights for you.
What is TwoCents? ×