We are here again! πΆ We are here again! πΆ Two Cents, we are here again!Β

Family, come and take control! π Readers, come and engage o! π

No mind me jare

Today na Sunday! Happy Sunday, everyone! β€οΈ

Just say make I start with morning devotion song π

I'm back with my drawing! βοΈ

But this one get small problem o

This guy no get eye, nose, and mouth! πΒ

You no go blame me abeg

Before you judge the artist, hear my side of the story first π

Those wey be anime lovers go sabi this guy even without eye, nose, and mouth

I drew this guy from one trending anime movie then

The movie title na Dr. Stone! π

And make I tell you, that movie interesting die! π₯

The story na battle between science and power (human strength)

Omo, the kind things wey happen for that movie ehn! π

So one day, I screenshot this guy from the movie and decided to draw am

I carry my pencil, face my paper, and do my artist work βοΈ

After I finished watching the movie, I deleted am because my phone memory no gree make i rest

But luckily, I still had the screenshot of the guy on my phone then

So I no worry myself. My reference picture dey safe, abi? π

Only for me to finish the drawing without drawing the eye, nose, and mouth that same day!Β

I said I would complete the face later

But before I knew wetin go sup next, the screenshot don disappear from my phone! π

And as if that one no do reach, I had already deleted the movie too!

Omo! Double tragedy π

How I wan take find the guy again?

I no even remember the season or episode wey I screenshot am from that timeΒ

Should I start watching the whole movie again just because of one person's eye, nose, and mouth?Β

Abeg o! I get other things to do with my life! π€£

So I just left the drawing like that and added am to my collection

And that was how this guy became a permanent member of the No Face Association! π

But the funny thing be say, some people wey don see the drawing and are familiar with anime still recognise the guy without seeing his face!Β

Omo, anime lovers no dey disappoint! π

If you know am, you know am!

If you no know am, abeg go meet your anime dictionary π

Β MAKE I TALK ABOUT THE MOVIE SMALL

Should I?Β

Okay o, since una don gather here, make I talk small. π

The guy na the scientist for the movie.

And guess wetin happen?

Everybody turned to stone!Β

I mean everybody o! The whole wide world in the movie!Β

Imagine waking up one day and discovering say everybody don turn stone

No school, no work, no market, no Two Cents! π

I no talk am o πββ‘οΈ

Wait first! If everybody turn stone, who go dey write the stories wey we dey read?Β

Who go dey comment?

Who go dey give insights?

Who go dey tip me? π€£

AbegΒ

Β Thank God say na only movie! π

Anyway, the movie is really interesting

But the next thing wey this guy did there ehn...

He ehemmmm... π€

Go and watch the movie if you want to know wetin happen next π

And that's the end of my story!

No throw me stone abeg o! πββ‘οΈπββ‘οΈ

Even the people for Dr. Stone don turn stone finish; make una no come join them turn me to stone because of this my drawing. π€£

Just pardon me na. This na the level wey I fit reach for now

To hear more of my stories subscribe by tipping me! π

Support your artist abeg π

Even if the face no complete, at least the hair don complete its assignment! π€£

Happy Sunday once again, everyone! β€οΈ

Make sure say una go church o!Β

And when you come back, no forget to engage with your boy!